Asake wey im real name na Ahmed Ololade dey very well known for im fashion sense wey include im giant trousers and skin tight tops.
But fans dey react differently to dis im new look.
Grammy-nominated artist, Asake, don show face for public yarn afta e unveil im new look for social media recently.
Di 'Lungu Boy' singer don cut im hair short and add face tattoos as e drop small video announce im new projects, including Why Love and Bad Boy.
Pipo for social media don dey hala on top di new look, especially di face tattoos.
Some people tok say di tattoos no fine for im face, some yarn say e go later regret am, while others dey worry say e fit affect im mental health.
News source na BBC pidgin