By Sunday, 19 January, TikTok go officially dey banned for di US.



Di US Supreme Court don gree with one law wey go ban TikTok for di whole kontri unless di China-based parent company, ByteDance, sell di app before Sunday.



TikTok bin argue say di law dey against free speech, as di app get over 170 million US users. But di Supreme Court no gree, so TikTok gatz find new buyer for di US version or dem go remove am from app stores and web hosting services.

Di White House tok say na di incoming President Donald Trump administration go handle di law matter, as e go take ova office on Monday. Trump don promise before say im go try save di app.

Both Democrat and Republican lawmakers don support di ban last year, sake of di fear say TikTok dey linked to di Chinese government. But TikTok don talk many times say dem no dey share info with Beijing.

Di law give ByteDance till 19 January to sell TikTok US version to avoid di ban.

If dem no sell, Apple and Google no go fit allow new users download di app or dey provide security updates, wey mean say di app fit vanish eventually. ByteDance don still tok say dem no go sell TikTok.