What is the meaning of Buy market in Nigerian pidgin

For Nigeria Pidgin, "Buy market" no mean say person just go buy something for market o! E get deeper meaning.

What does buy market means in pidgin


Buy market mean say person don enter wahala wey no concern am or e don put hand for matter wey go give am problem. E fit be say person chook mouth for quarrel wey no be im own or e do something wey go bring kasala. To put yourself in trouble especially when the situation didn't even concern you.

Example Use:


1. No go chook mouth for their fight o, make you no go buy market. (No involve yourself for their fight, so you no go enter trouble.)


2. That guy slap police, e don buy market be that! (That guy slap police, he don enter big wahala.)

1. You see two lovers dey quarrel, you go put mouth? Abeg no buy market o!
(You see two lovers arguing, and you want to interfere? Please don’t invite trouble for yourself!)


2. That guy no dey hear word, I warn am make e no owe those agbero, now e don buy market.

(That guy doesn’t listen, I warned him not to owe those street guys, now he’s in big trouble.)


3. Madam go insult her landlord, now dem don give am quit notice. She don buy market.
(Madam insulted her landlord, and now she has been given a quit notice. She has brought trouble upon herself.)