Mama Salome Adaidu Cry Out for Justice for her daughter wey one man cut am head


Mama of late Salome Adaidu, Mrs. Ojomachenwu Adaidu, don narrate how she take hear di sad news of her daughter death and wetin happun before di tragedy. She tok her mind give BBC News Pidgin, as she beg make justice show face for her pikin case.




Mrs. Adaidu explain say she bin dey sick and stay for her village wen di incident happun. She say na police officer call her wit di sad tori. "I bin dey sick and I dey for village wen I hear di news," she tok, wit tears for her eyes.

She describe her daughter Salome as pesin wey no too like plenty friends. "Salome no be pesin wey get many friends. She dey her own, quiet and focused," di grieving mama add. She say wetin she dey ask now na justice for her pikin wey no fit talk for herself again.

See the full details, how the daughter head been cut 


Di first born of di Adaidu family, Patience Unekwuojo Adaidu, also clear di air about di matter. She tok say di Timileyin Ajayi wey dem link to her sister death no be Salome boyfriend. "Timileyin no be her boyfriend. Our family no sabi di guy at all," Patience yarn.

Di Adaidu family dey in pain as dem dey try find answers and justice for Salome. Dem don beg di authorities make dem investigate di matter well and make sure say anybody wey get hand for di incident face di law.

As di case dey go on, di family dey hold onto di memory of Salome and dey pray say justice go prevail.