Why some women no dey reach climax but others dey rush like water



Di matter of female orgasm still be one big mystery for scientists and doctors wey sabi sexology well. Dem don write plenty tins about di way women dey enjoy orgasm, but no be all women dey fit experience am. Some women even tok say dem neva feel orgasm for dia life before.

This Tori na for readers wey don reach 18 years.

For dis context, climax na di point of maximum sexual pleasure wey person fit experience during sexual activity. For women, e dey often describe as di intense feeling of release or satisfaction wey follow di buildup of sexual excitement.



Na wetin be dis climax sef?

Dis climax na wetin people dey call orgasm, and e dey involve physical reactions like muscle contractions around di pelvic area, increased heartbeat, and deep emotional pleasure. But no be all women dey fit reach dis stage, and na why di topic still dey generate plenty discussion among experts.



Plenty factors dey affect why some women no dey climax, and dem include:


1. Trauma from past experience


If woman don experience bad or traumatic situation before, e fit affect her ability to enjoy sex. Di best tin na for her to tok wit her partner about di matter so dat di partner go understand and support her. But if she no fit share di experience, e good make she find professional help from counsellors or therapists to work on di trauma.




One expert, Héctor Galván, explain say di shame or fear wey some women dey carry from dia past experience fit make dem no wan tok about wetin happun. If di woman no fit tok wit her partner, she fit work wit therapist confidentially to improve her sex life.

2. Stress and rushing


Stress na one big reason why some women no dey reach orgasm. Di expert talk say for woman to climax, her body and mind gatz dey relaxed. But wit di kind busy lifestyle wey some women get – from work, children, and oda responsibilities – dem no fit relax well for di sexual encounter.

Stress fit make women wan fake orgasm just to end di sex quickly or to protect dia partner's ego, but e better to tok about di issue and work on am together.


3. Lack of sexual desire


Di UK National Health Service (NHS) tok say lack of sexual desire dey affect women for different stages of dia life, like pregnancy, afta childbirth, menopause, or during stressful periods.

Depression, use of some medications, and hormonal imbalance fit also reduce di urge for sex, and di drop in testosterone levels fit play role too.

4. Self-pressure


If woman wey dey climax before suddenly no fit reach orgasm, she fit begin dey worry herself. Dis self-pressure go only create tension wey go make am harder for her to climax. Relaxation and enjoyment dey very important for dis kain situation.

5. Pain during intercourse


Some women dey suffer from condition wey dem dey call dyspareunia, wey dey cause pain, burning, or discomfort during sex. Dis kain pain fit even start before or afta di intercourse, and e go make orgasm impossible.

6. Relationship problems




Sometimes, di root of di problem fit dey di relationship. Di expert talk say if couple dey face issues for dia relationship, e fit affect dia sexual life too. Di solution na to focus on fixing dose hidden relationship problems wey dey affect dem.

Final advice


Di best way forward na to address di root causes of di problem. Women need to tok wit dia partners, take out time to relax, and if necessary, seek professional help. Solving di matter no only improve di sex life, e dey also help di relationship overall.

This Tori na from BBC pidgin